Wia dis foto come from, John Mbadi
National Assembly minority leader wey dey represent Suba South for Kenya Parliament, John Mbadi don explain why e punch im colleague, Benard Koros for eyes during plenary session.
Lawmaker Mbadi tell tori pipo say na di colleague hit am first as dem dey discuss one controversial Political Parties Amendment Bill for di floor of di house.
Di mata lead to serious kasala for di house as live video show as lawmakers begin throw blows, punches and bottle water at each oda.
Di minority leader also don chop five days suspension from plenary sessions.
Mbadi explain say “MP Koros bin wan vote for one member wey dey absent and di clerk bin don advise am say e no fit vote even di Chairman tell am same thing. I come tell am to leave because time dey go.
“Di Honourable member come charge at me and for di process bite my finger. Wetin you want make I do, make I siddon dey look as e dey bite me? If e receive di same thing back as defence, e dey okay.”
Di minority leader add say e dey wrong for di temporary Speaker Christopher Omulele (Luanda) to suspend am from sittings as process dey before you fit suspend any lawmaker.
Di Sigowet/Soin legislator wey blood dey comot from im face complain give di Speaker say im dey attacked by Mbadi during di session.
“Mr Speaker I don dey attacked for di House by di master of violence for dis House, e dey very wrong say I fit dey injured by an Honourable House Mr Speaker,” e tok.
Koros say im no deserve to dey attacked for di House for carrying out im duty as a Member of Parliament.
“Mr Speaker I deserve to vote like other members, I no fit dey attacked for carrying out my duty,” he add.
However, di temporary Speaker Christopher Omulele (Luanda) order di Suba South Member of Parliament to comot di plenary immediately for wetin e describe as gross misconduct, fighting im colleague and disrupting di special sitting wey dem dey hold to discuss di controversial Political Parties (Amendment) Bill.
Di speaker suspend Mbadi for five days and direct lawmaker Sigowet/Soin MP Benard Koros wey get injury for face to go hospital pending further directives from di Speaker.
“Hon Mbadi you dey directed to leave di grounds of dis House for gross disorder. You dey ordered to withdraw for a minimum of five days,” Temporary Speaker Omulele rule.
Wia dis foto come from, NTV KENYA
Di wahala start when di MPs begin vote on one proposed amendment by Kandara MP Alice Wahome wey dey seek to delete one clause on di establishment of a Coalition Party.
Wahome argue say di Clause 6 dey unconstitutional make dem remove am.
“You no fit come up wit new terminology to legislate wetin dey di constitution. Coming up wit Coalition Political Party go offend di constitution,” said Wahome.
She add join say, “Dis House no suppose act in vain. I no dey here to please you but to prosecute my amendments. These pipo lost for 2013, 2017 and BBI. Dem go lose for 2022.”
Kasala burst as e reach time to vote for who dey in support or against di amendment.
Clause 6 provides, among other things, di procedure wey suppose dey followed for di registration of a political party, wey include di deposit of a coalition agreement.
E further provide say di governance of a coalition party go dey in accordance wit di provisions of di Act and regulations relating to di governance of a coalition.
Di clause also provide say a member of a coalition no go be member of another coalition.
Uhuru and Raila parties dey seek to change di law and have parties join Azimio la Umoja Movement without losing their identity.
Wia dis foto come from, Getty Images
Politics for Kenya parliament dey known to dey highly animated and partisan
Dis no be di first time fight dey happun for Kenya parliament.
For 2016, parliament session for Kenya bin turn to boxing ring as rival MPs trade punches.
Opposition lawmakers bin try to block discussions on di introduction of manual vote-counting for next year’s presidential election.
Goment want back-up to di electronic system but di opposition say na way of rigging di poll.
For 2014, four lawmakers dey assaulted and dem tear di shirt of one of dem.
Kenyan politics dey known to dey highly partisan.
© 2022 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.