Categories: human rights

Missing Takoradi pregnant woman: Josephine Mensah husband, Ghana Minister, doctor disagree on 'missing pregnancy' – BBC

Wia dis foto come from, Other
Ghana Police Service say di tori of one Takoradi woman wey go viral recently say she dey kidnapped and she get belle no be true.
Di police for inside statement say di suspect, Josephine Panyin Mensah afta investigation don confess say she no get belle and she no dey kidnapped.
Tori of di 28 year old bin go viral afta her husband, Michael Simmons insist say im wife wey dey missing from September 16th bin get dey nine months pregnant.
Earlier, police suspect say di story na fake wit dia preliminary investigation.
28-year-old Ghana woman wey go missing after alleged kidnappers release am take new turn.
Dis be sake of conflicting reports emerge about whether she be pregnant or not.
Latest information from Western Regional Minister, Kwabena Okyere Darko-Mensah be say she no be pregnant based on preliminary report.
“According to de police, dem dey suspect say de story be fake per dema preliminary investigations.”
“De medical doctor who attend to her even suspects say she no be pregnant as people dey report,”
Western Regional Minister, Kwabena Okyere Darko-Mensah add.
He make dis revelation to local radio, Kessben TV say dis be preliminary security report he get from de National Intelligence Bureau (NIB).
Wia dis foto come from, Other
Micheal Simmons, husband of de lady wey go missing insist say en wife be nine months pregnant.
He refute de claims say she no be pregnant.
He explain give Accra-based Citi News say “she be pregnant for nine months.
De problem be when she dey go hospital, I no dey go with her. She always dey go alone,” he add.
Dis new information dey confuse de general public sake of her husband still dey insist say en wife, Josephine Mensah be pregnant.
Eyewitness wey find de lady after alleged kidnapping explain say he at de time he find her, she no dey talk except say she dey give gestures with her hands.
She give number of her pastor on paper who dem call, later family of de young lady come to de scene.
De family of de lady, Josephine Mensah say she go out for morning walk around Paa Grant Roundabout as part of her morning exercise last week Thursday.
Strange calls from unknown people give away de possibility say some people kidnap her.
Accra-based Citi News report say her brother in law explain that she no longer dey show signs of pregnancy wey she no dey carry newborn baby too at de time of her rescue.
Wia dis foto come from, Other
Ghana Police since de rescue of de young lady no provide any details on de incident.
Josephine however dey receive medical care for hospital.
© 2022 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Facetvnews

Share
Published by
Facetvnews

Recent Posts

Alan Kyerematen Commits to Completing the Greater Kumasi Industrial City Project

By Femi .October 4, 2024 Hon. Alan John Kwadwo Kyerematen, the leader and presidential candidate…

2 weeks ago

Notable wars in African and global history:

Major Wars in Africa and Beyond: A Chronological Journey War and conflict have shaped the…

4 weeks ago

The Rise of Levic Muzik and Legacy Of His Father Appietus

capture levic muzik Levic Muzik: Following in His Father’s Footsteps Appietus' son, Nkunim Appiah Dankwah,…

1 month ago

Nigeria Faces Severe Flooding Crisis in Maiduguri After Dam Overflow

Maiduguri, the capital of Borno State in northeastern Nigeria, is facing its worst flooding crisis…

1 month ago

Ghana Increases Cocoa Price by 45%

The Ghanaian government has announced a 45% increase in the producer price of cocoa for…

1 month ago

Lenovo’s New Laptops Feature Intel-Powered Innovations

Lenovo has announced two new laptops, the ThinkPad X1 Carbon Gen 13 and Yoga Slim…

1 month ago

This website uses cookies.